Wednesday, 27 July 2016

Mikel to be team nigeria captain in Rio

John Obi Mikel © Getty Images

John Obi Mikel go be skippo for de Naija Team athletes for di 2016 Olympic Games wey go shele for Rio de Janeiro, Brazil.

Na di sports ministry for Naija wey tok am say dem don pick di ogbonge Chelsea midfielder as na him dem take as sabi player wey Youngee players fit copy dey show dia swagger for Rio.

Di 29-year-old be one of di over-aged players wey dem name for Naija Under-23 national team for di men's football event wey go hapun for di Olympics.

Dis be di fess time wey Mikel dey appear for di Olympic Games.

But na table tennis star Funke Oshonaike dem name di assistant skippo.

"Mikel be young, patriotic footballer wey be international standard, and we bilif hin go be role model for athletes wey jus dey come up, while Funke Oshonaike gada experience well well and be one of di oldest athletes for di team, our bilif be say dia combine effort go bring betta thing for Team Naija and dem go show di world say Naija dey kampe", naso di head of mission, Christian Ohaa tok am.

Di Olympics for Brazil go shele between August 5 and 21.

No comments:

Post a Comment